29 As e dey pray, en face shange and en klot kon dey shine like lite.
E nor go tey again before una go si one good king wey dey rule well with one kingdom wey big and wide well-well.
My savant grow like seed wey dem plant for dry groun. E nor even get beauti or respet wey go make us notis am.
Jesus body kon shange. En face kon dey shine like sun and en dress kon white.
Afta, Jesus still appear to two pipol as dem dey waka go town.
So wen all di pipol don baptize, Jesus ensef kon baptize too. Wen e dey pray, heaven open,
But Jesus komot go pray for wildaness, where pipol nor dey.
Jesus go mountin go pray and e dey der dey pray to God till day break.
As Jesus dey pray alone and en disciples dey near am, e kon ask dem, “Na who pipol dey tok sey I bi?”
At wons, Moses and Elijah kon dey tok with am.
Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.
Evribody wey dey di kansol dey look Stefen kon si sey en face dey shine like angel own.
Den I si one big white throne and di Pesin wey sidan put. Eart and heaven run komot from en present and dem nor si where to hide put.