19 Dem ansa, “Some sey yu bi John di Baptist, odas sey yu bi Elijah and odas still sey yu bi one old profet wey wake-up from deat.”
Make una si, I go send Profet Elijah kom meet una, before God Judgement Day go kom.
so e kon tell en savants, “Dis na John di Baptist wey wake-up from deat! Naim make am get pawa to do all dis mirakle.”
For dat time, John di Baptist dey prish inside wildaness for Judea sey,
King Herod kon hear wetin dey happen, bikos pipol don know Jesus name well-well. Some pipol sey, “John wey dey baptize don wake-up from deat and bikos of dis, e don get pawa to do mirakles.”
Odas sey, “Na Elijah e bi.” Some kon sey, “E bi like one profet wey dey before.”
As Jesus dey pray alone and en disciples dey near am, e kon ask dem, “Na who pipol dey tok sey I bi?”
Den Jesus ask dem, “But who una tok sey I bi?” Pita kon ansa, “Yu bi di Mezaya wey God send.”
Den dem ask am, “So, na who yu bi? Abi yu bi Elijah?” E kon sey, “No, I nor bi Elijah.” Dem ask am again, “Yu bi di profet?” E ansa, “No o-o!”
Dem kon ask John sey, “Why yu dey baptize pipol, if yu nor bi di Christ or Elijah or di Profet?”
Wen pipol hear wetin e tok, some for dem kon sey, “True-true, dis man naim bi di Profet!”
Dem ask di man wey blind before sey, “Wetin yu tink about di man wey make yu dey si?” Di man ansa, “Na profet e bi.”