Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 9:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Den Jesus take di five bread and two fish, e look heaven, tank God, den e kon divide dem. E give di bread and fish to en disciples, make dem share am for di pipol.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 9:16
16 Iomraidhean Croise  

Den e tell di pipol make dem sidan for di grass. E take di five bread and two fish face heaven kon tank God. Afta e don tank God, e share di bread give en disciples make dem give di pipol.


kon take di seven bread and di fish. Afta e don tank God, e divide di bread and fish give en disciples make dem share am for di pipol.


Den e look heaven kon sey, “Efratah!” (wey mean, “Make yu open”).


Den Jesus take bread, afta e tank God, e divide am kon gi-am to dem sey, “Na my body bi dis, wey God don give una. Make una dey always do dis tin to take remember mi.”


E sidan for where dem dey chop; e take bread, bless am kon divide am give dem.


Di disciples do as Jesus tok and all di pipol kon sidan.


Evribody chop beleful and wen dem gada di food wey remain, e full twelf basket.


Jesus take di bread kon tank God. Den e divide am give di pipol wey sidan. E do di same tin with di fish. All of dem chop as dem wont kon beleful well-well.


So some kenu wey kom from Tiberias kon rish di wotaside near di place wey dem for chop bread, afta Jesus don pray.


Wen Paul tok finish, e take bread kon tank God for dia front make all of dem si and e start to chop.


Anybody wey tink sey one day betta pass anoda, dey do so to honor God. And anybody wey chop meat, dey tank God just like di pesin wey nor won chop.


If I tank God for my food, wetin go make anybody fight mi bikos of di food wey I tank God for?


and afta e don tank God, e divide am kon sey, “Dis na my body wey I dey give una. Make una always dey chop am to remember mi.”


And wen una enter di town, una fit si am, before e go-go chop for di altar for di hill. Di pipol nor go chop until e kom, bikos e must bless di sakrifice. Wons e don bless am, doz wey dem invite go bigin chop. Naw make una dey go, bikos na naw una go fit si am.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan