Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 8:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 But di ones wey fall for betta groun, grow kon bear pass hundred seed.” Den Jesus sey, “Anybody wey get ear, make e hear!”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 8:8
25 Iomraidhean Croise  

Isaak harvest plenty well-well and e rish hundred times of wetin e plant dat same year, bikos God don bless am.


Na God give us eyes to si tins and ear to hear word.


Make una hear mi! Wisdom dey koll pipol and undastandin wont make dem hear en vois.


Den I tell Israel pipol, “God don tok! So make una dey honbol and listin to am!


Una nor go listin or hear, even doh God dey always send en savants kom meet una.


Anybody wey get ear, make e hear!


But di seed wey fall for betta groun, na pesin wey hear and undastand God word. E kom bear fruit wey rish hundred, sixty and thirty.’ ”


But di ones wey fall for betta groun, na doz wey hear di word kon receive am and bear many fruits, some bear rish thirty, some sixty and some hundred.”


If anybody get ear, make e hear wetin I dey tok!”


But odas fall for betta groun. Dem grow well kon bear oda seeds, some bear rish thirty, some sixty and some hundred.”


Anybody wey get ear, make e hear wetin I dey tok.”


Pipol nor go fit use am do anytin, na trowey dem go trowey am. Anybody wey get ear, make e hear wetin I dey tok!”


But di seeds wey fall for betta groun, na di pipol wey hear God word, hold am with betta mind, dey obey God and bear wahala, so dem kon bear plenty fruit.”


Odas fall for where shuku-shuku dey and wen dem grow, di shuku-shuku grow too, kon shuk dem die.


God kreate us thru Jesus Christ as di good work wey E don prepare down before, so dat wi go dey do as E plan.


den una life go betta just as Christ wont. For all di good tins wey una dey do, make una dey bear fruit and learn to know God more-more.


If anybody get ear, make e hear!


Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, di sekond deat nor go kill-am.’ ”


Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, I go allow am chop from di tree for God Paradise and dis tree dey give life.’ ”


Anybody wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church.’ ”


Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church.’ ”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan