56 Di papa and mama sopraiz well-well, but Jesus kommand dem make dem nor tell anybody wetin happen.
Den, Jesus tell am, “Nor tell anybody, but go meet di priest, make e look yu. Afta, go give di ofrin wey Moses kommand to show sey yu don well.”
At wons, dia eyes kon open and dem kon bigin si. Jesus kon warn dem sey, “Make una nor tell anybody wetin happen so.”
Jesus tell di man, “Make yu nor tell anybody, but go show yorsef to di priest and pay di ofrin wey Moses kommand sey, pipol wey dia leprosy don komot for dia body go bring, so dat di priest go know sey yu don really well.”
Naim di girl spirit enter di body back and e kon get up at wons. Den Jesus tell dem make dem give di pikin food chop.