Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 8:42 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

42 bikos e only dota wey don rish twelf years, dey die. As Jesus dey go di man house, pipol kon dey waka jam am anyhow bikos dem plenty.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 8:42
15 Iomraidhean Croise  

Somebody fit dey alive for morning kon die for nite, before odas go know.


Who know wetin good for pesin for dis yuzles and short life wey wi dey live? Life wey bi like shadow, how wi won take know wetin go happen for di world afta wi don die?


“Man pikin, na one blow I go take kill di pesin wey yu love pass. Make yu nor tok or kry.


God kon sey, “Man pikin, I go remove di strong temple wey bi dia joy and pride. Di temple wey dem dey like to look and visit. I go still take dia shidren komot dia hand.


“Den I go pour my spirit to pray and to show mesi for David shidren-shidren body and di oda pipol for Jerusalem. Dem go dey look mi, di pesin wey dem shuk, den dem go mourn like pesin wey dey mourn en only pikin. Dem go kry well-well like sey na dia first boy pikin die.


Jesus and plenty pipol kon follow am and di pipol dey push Jesus from evry korna.


Near di town gate, dem meet pipol dey karry one dead body go beri. Di man mama na widow and naim bi di woman only pikin, so plenty pipol from di town kon follow am.


Den Jairus wey bi oga for di sinagog waka kom. E fall for groun near Jesus leg, dey beg am make e kom en house,


One woman dey among dem wey don dey mestrate for twelf years naw, bikos nobody fit heal am.


Den Jesus ask, “Na who tosh mi?” Wen evribody sey dem nor know, Pita kon tell Jesus, “Oga God, plenty pipol gada round yu and all of dem body dey tosh yu!”


Na thru one man sin enter dis world and deat kom thru sin. So wi must die, bikos evribody don sin.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan