34 Wen di pipol wey dey keep di pigs si wetin happen, dem run go inside town bigin spread di news.
As dem dey go, some for di guards go inside di town go tell di priest oga dem evritin wey happen.
Di pipol wey dey look di pigs, run go di town kon tell pipol evritin wey happen to di men wey get demons.
So, di men wey dey guide di pigs for der, run go spread di news for di town and pipol for di aria kon go look wetin happen.
Di demons komot for di man body go enter di pigs and all of dem rush enter di river go die.
So pipol run kom si wetin dey happen and dem meet Jesus for der. Di man wey Jesus drive demon komot for en body, don well and e wear klot sidan near Jesus leg, so fear kon katch di pipol.