So di news about Jesus kon spread go evriwhere for Siria. Dem kon bring pipol wey nor well, wey nor fit waka, pipol wey devil dey worry and di pipol wey demon dey inside dem, kom meet am and e heal all of dem.
and some wimen wey Jesus drive evil spirit and difren sickness komot for dia body, go with am: Mary (wey dem dey koll Magdalin), wey Jesus drive seven demon komot for en body,
E shaut, bikos Jesus don first kommand di evil spirit make e komot for en body (bikos di evil spirit don disturb di man well-well and dem dey shain and guide am. But e dey break di shain and di demon go drive am go inside wildaness.)