6 So Jesus follow dem go. As Jesus near di house, di soja kon send some for en friends go meet am sey, “Oga God, nor trobol yorsef, bikos I nor big rish who yu go enter en house.
I nor deserve all di good tins and kindness wey Yu don show mi, yor savant, bikos na with only my rod I take cross Jordan River, but naw, I don divide my family and propaty into two.
“I dey baptize una with wota make una for turn from sin kom meet God, but di pesin wey go kom afta, strong pass mi. I nor big rish to luz di rope wey dey en shoe, na-im go baptize una with Holy Spirit and fire.
Jesus Christ wey kom from Nazaret, na-im God give di Holy Spirit and pawa. Una still know how e do good for evriwhere kon heal pipol wey devil dey opress, bikos God dey with am.
But E give us plenty grace. Na dis make God word sey, “God dey against pesin wey dey karry body up, but E dey give grace to pipol wey dey put dia body down.”