So David stand up go baf; e komb en hair kon shange en klot. Den e go woship for God house. Wen e rish di palis, e ask for food and e chop am as dem just bring am.
so e send for one wise woman for Tekoa. Wen di woman kom, Joab tell am, “Make yu do like sey yu dey mourn; wear mourning klot kon skata yor hair. Make yu bihave like woman wey don dey mourn since.
Even wen una plant, una nor go harvest anytin. Una go press una olive fruit, but una nor go get enough oil to anoint unasef. Una go mash di grape, but una nor go get any wine to drink.
So make yu baf well-well, rub oil wey dey scent kon dress well. Den go where e for dey work. But nor let am know sey yu dey der until e don chop finish.