45 Wen I enter yor house, yu nor kiss or greet mi as awa tradishon bi, but since I enter, dis woman neva stop to kiss my leg.
Den Jakob kiss Rashel kon dey kry.
But Esau run go meet am kon hug and kiss am. Den di two of dem kon dey kry.
Wen anybody waka go bow for Absalom, e go hold di pesin stand up kon kiss am.
Den David and all en men cross Jordan River. E kiss and bless Barzillai and Barzillai kon go back to en house.
(Naw, di pesin wey sell am, don give dem sign sey, “Di pesin wey I go kiss, naim bi di man. Make una arrest am!”)
Make una salot one anoda with kiss for jaw. All di church wey bi Christ own, dey greet una.
All di brodas sey make I greet una.
Una wey bi papa, make una nor make una shidren vex, but make una raiz dem to follow Christ tishing.
Make una greet all di brodas and sistas as God wont am.