4 Wen dem si Jesus, dem beg am well-well sey, “E good make yu kom help am,
“Wen una enter any town or village, make una look for pesin wey ready to receive una for en house, make una stay with am until una komot from dat town.
And if di pipol inside di house welkom una, make una peace stay with dem, but if dem nor welkom una, una peace go kom back to una.
But di pipol wey God go wake-up from deat karry go heaven, nor go marry.
Wen di soja hear about Jesus, e kon send some Jew eldas go meet am sey, make e kom heal en savant.
bikos e love awa pipol and e even build sinagog for us.”
E dey holy and en and en family dey woship God. E dey help di pipol well-well and dey pray to God evritime.
But yu get some pipol for Sardis wey neva stain dia klot, dem go wear white klot follow mi waka, bikos dem deserve am.