34 But God Pikin kom, dey chop and drink and una sey, ‘Si am, long-trot, drunkard, na tax kollectors and sinnas bi en friend.’
But wen Man Pikin kom, e chop and drink and una sey, ‘Si am, long-trot, drunkaman, tax kollectors and sinnas friend!’ But God wisdom dey show for wetin e dey do.”
If una love only di pipol wey love una, wetin una go gain? Na so bad pipol dey do too, abi nor bi so?
Wen di Farisee si wetin dey happen, dem kon bigin ask di disciples, “Wetin make una tisha dey follow tax kollectors and sinnas dey chop?”
As Jesus dey tok, one Farisee koll am kom en house kon chop, so Jesus go sidan for where dem go for chop.
For one Sabat Day, wen Jesus go chop for one Farisee oga house, di pipol kon dey look am,
But di Farisee pipol and di law tishas dey komplain sey, “Dis man dey follow sinnas chop.”
Wen di pipol si wetin happen, dem kon dey komplain dey sey, “Jesus don go visit dat man wey bi sina.”
Den Levi do party for en house bikos of Jesus, so many tax kollectors and oda pipol kom chop with dem for di party.
Wen John di Baptist kom, e nor chop food or drink wine, but una sey, ‘E get demon!’
But doz wey get wisdom, know sey evritin about am, na trut.”
One Farisee kon invite Jesus kom chop for en house, so Jesus enter di Farisee house kon sidan.
So dem kon do party for Jesus dat evening. Marta kon dey serve dem food and Lazarus dey among di pipol wey sidan for tabol with Jesus.
Dem invite Jesus and en disciple for di marriage too.