26 Wetin una go out go si? Na profet? Yes! I tell una, e even big pass profet.
And yu, my pikin, pipol go koll yu God profet and na yu go-go prepare di road for di Oga God,
“Moses Law and di tins wey di profets rite, naim pipol dey follow, before John di Baptist kom. But since e kom, dem don dey prish di Good News about God Kingdom and evribody won force ensef enter.
But if wi sey, ‘Na from pipol’, dis pipol go stone us, bikos dem bilive sey, John na profet.”
Wetin una go out go si? Na man wey wear fine klot? No! Bikos pipol wey dey wear fine klot and dey enjoy life, na king palis dem dey stay.
Dis na wetin dem rite about am, “ ‘I dey send my messenja go yor front, wey go-go prepare yor road for yu.’
John lite shine well-well for small time and una happy wen una si en lite.”