Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.
So, God go give una sign by ensef. One yong woman wey neva ever sleep with man before, go get belle kon born boy pikin and dem go koll am, ‘Immanuel, wey mean, “God dey with us.” ’
But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.
Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.
But for una wey dey fear my name, my sun wey dey give life go shine and heal una. Una go dey free kon dey happy like melu pikin wey dem open en kage make e for go play.
One day Jesus dey pray for one place. Wen e pray finish, one of en disciples kon tell am, “Oga God! Make yu tish us how to pray, just as John tish en disciples.”
Jesus ansa, “Who bi di manaja wey get sense and nor dey do wayo? Na pesin wey di oga put make e kare and give di oda savants dia food for di rite time?
But Zakius stop kon tell Jesus, “Oga God si, I go give half of wetin I get to poor pipol and evribody wey I don shit before, I go pay am back four times!”
Den Jesus turn look Pita for eye and Pita kon remember di word wey Jesus tell am, “Before fawol go do ‘Kukuruku!’ dis nite, yu go don tok three times sey yu nor know mi.”
Joshua kon send two pipol from Shittim kamp go spy Kanaan land especially Jeriko town. Wen dem rish di town, dem kon go sleep for one ashawo house and di ashawo name na Rahab.