So di news about Jesus kon spread go evriwhere for Siria. Dem kon bring pipol wey nor well, wey nor fit waka, pipol wey devil dey worry and di pipol wey demon dey inside dem, kom meet am and e heal all of dem.
King Herod kon hear wetin dey happen, bikos pipol don know Jesus name well-well. Some pipol sey, “John wey dey baptize don wake-up from deat and bikos of dis, e don get pawa to do mirakles.”