10 So, wen doz wey di soja send go back to di house, dem kon si sey di savant don well.
So Jesus tell am, “Madam, yor faith big well-well! Make wetin yu dey find rish yor hand.” Dat same time, di pikin kon well.
Den Jesus tell di offisa, “Go, since yu bilive, na so e go bi for yu.” Na dat same time di savant well.
Den Jesus ask am, “Yu mean, ‘If I fit?’ Evritin dey possibol for di pesin wey bilive.”
Afta, Jesus go one town wey dem dey koll Nain, en disciples with many pipol follow am.
Wen Jesus hear dis, e sopraiz and belle sweet am, naim e look di pipol wey dey follow am kon tell dem, “I tell una true word, I neva si dis kind faith before, even for Israel.”