Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 6:41 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

41 “Why yu dey look di small dirty wey dey yor broda eye, but yu nor dey si di big wood wey dey yor own eye.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 6:41
18 Iomraidhean Croise  

God go ponish Joab for doz pipol wey e kill, wey David my papa nor know about. Joab kill two innocent men wey betta pass am: Abner wey bi Israel soja kommander and Amasa wey dey kommand Judah sojas.


Bikos Joab nor won bin do wetin di king kommand am, e nor kon kount Levi and Benjamin tribe.


Bikos dem blind, dem nor fit si as dem really wiked rish.


Na wikedness full human being mind and e bad well-well. Na who go fit undastand am?


bikos e si sey wetin e dey do nor good, so e kon stop to dey sin. E nor go die at-all, but e go live.


“Make una nor dey judge pipol anyhow, so dat God nor go judge una.


Dem still get some small-small fish too and afta Jesus don tank God, e kon tell en disciples make dem share am for di pipol too.


No student go fit big pass en tisha, but wen e don learn finish, e go bi like en tisha.


How yu go take tell yor broda sey, ‘Broda, make I remove di dirty wey dey yor eye, but yu nor dey si di wood wey dey yor own eye? Yu wey dey pritend, make yu first komot di wood for yor eye, den yu go si well to fit remove yor broda own.’


Wen dem kontinue to dey worry am, e kon get up tell dem, “Any of una wey neva kommit sin before, make e bi di first pesin to stone dis woman.”


Pesin wey dey judge odas nor get eskuse for wetin e dey do and e nor matter who en bi. Bikos wen yu judge odas and yu dey do di same tin wey dem dey do, yu dey kondemn yorsef.


Wen di pesin look ensef finish kon komot go out, e go kwik-kwik forget how en face bi.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan