29 If anybody slap una for face, make una turn di oda side gi-am too. If anybody use force kollect una koat, make una gi-am una shirt join too.
Mefiboshet ansa, “Make Ziba take evritin! My king, as yu kom house save, dat one don do for mi.”
Den Profet Zedekaya wey bi Kenaana pikin, waka kom meet and slap Mikaya, den e ask am, “Since wen God Spirit leave mi kon dey tok to only yu?”
I dey open my back to pipol wey dey beat mi. I nor dey stop dem wen dem dey curse mi; even wen dem dey pul di hair wey dey my face komot.
Pesin wey dem slap for one side, make e turn di oda side. Make e nor tok wen en enemies dey curse am.
Jerusalem pipol, make una gada unasef like sojas, bikos enemies dey hide won kon attack una. Dem go use rod take nak Israel leaders face.
Dem kon spit for en face, beat am and some slap am,
Dem tie en eye kon dey ask am, “Oya profesai! Na who nak yu so?”
Make una give evribody wey ask una for sometin and if anybody take wetin bi una own, make una nor ask for am back.
Afta Jesus don tok finish, one of di High Priest savant, wey stand near am slap am for face kon ask am, “Na di High Priest yu dey tok to like dis?”
Bikos of wetin e tok, Ananias wey bi di High Priest kon orda di pipol wey stand near Paul sey make dem slap am for mout.
Even today, wi dey hongry for food and wota, na only rag wi get to wear. Dem dey trit us anyhow and wi nor get house to stay.
Wen una take unasef go kourt, dat mean sey all of una don luz.
Una like make pesin turn una to slave; use and shit una; take evritin wey una get, den beat and slap una anyhow.
True-true, una sofa like oda prisonas and una dey happy wen dem seize all una propaty, bikos una know sey una get betta tin wey go last forever.