Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 6:28 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

28 Make una bless doz wey curse una and pray for doz wey dey trit una anyhow.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 6:28
13 Iomraidhean Croise  

King Jeroboam tell di profet, “Abeg! Make yu pray to di Oga yor God for mi sey, ‘Make E heal my hand!’ ” So di profet pray to God and di king hand kon strait again.


God wey get pawa sey, “Filistia pipol don revensh and kill Judah pipol well-well, bikos dem hate Judah.


I dey vex naw, so mi wey bi God go ponish dem especially Edom pipol, bikos na dem laf una pass kon kollect una land.


But I tell una naw sey, ‘Make una love una enemies and pray for pipol wey dey sofa una’,


(Den Jesus kon sey, “Papa, make yu forgive dem, bikos dem nor know wetin dem dey do.”) So, di sojas kon gambol to know who go take Jesus klot.


“But I dey tell una wey dey listin, ‘Make una love una enemy and do good to pipol wey hate una.’


But make una love una enemies kon do good and make una nor espect anytin back wen una borrow anybody sometin. Na dis go make God pay una back and una go bi en shidren, bikos God ensef dey do good for wiked pipol and doz wey nor dey sey tank yu.


Di Gentile and di Jew pipol (with di oga dem wey dey rule dem) kon dey try to sofa and stone di disciples,


So e fall for groun kon shaut, “My Papa, abeg, make yu nor kount dis sin against dem.” Wen e tok so finish, e kon die.


Make una nor curse pipol wey dey opress una, but make una pray make God bless dem.


Wi dey work hard before wi go fit chop and as pipol dey curse us, na blessing wi dey give dem back. Wen wi dey sofa, wi dey-dey patient.


My brodas and sistas, na di same tongue wi dey use take praiz and curse pipol. But e nor suppose bi like dat.


Make una nor take bad pay di bad wey pesin do una, instead, make una bless odas, bikos God koll una to bless pipol.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan