Di glory for dis new temple go big pass di old one and na for der I go for give my pipol peace and make dem prosper.” Dis na wetin Oga God, wey dey mighty, tok.
“Wen una dey fast, make una nor skwiz una face like pipol wey dey pritend, so dat pipol go si sey dem dey fast. I tell una true word, dem don already get dia full reward.
“Anytime una give sometin to pipol, make una nor show unasef as pritendas dey do for dia sinagog and road, so dat oda pipol go praiz dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.
“Anytime wey una dey pray, make una nor do like pipol wey dey pritend, wey like to dey stand pray inside sinagog and for road, so dat pipol go si dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.
Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life.