Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 6:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 and una go dey happy for dat day. “Make una happy well-well, bikos di reward wey una go get for heaven, go big well-well. Na so dia grand-grand papa dem tok about di profets too.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 6:23
45 Iomraidhean Croise  

As dem bring di box kom di town, Mikal wey bi Saul girl pikin look from window and e si David as e dey dance well-well with only linen klot, di woman kon dey shame, bikos of David, en husband.


Wen Jezebel dey kill God profets, Obadaya hide hundred profets for two kave; fifty-fifty for each kave and e dey bring food and wota kon give dem.


E ansa, “My Oga God wey get pawa, na only Yu I dey serve, but Israel pipol don break di kovenant wey dem make with Yu. Dem skata yor altar kon kill all yor profets. Na only mi remain and dem won kill mi too!”


E ansa, “My Oga God wey get pawa, na only Yu I dey serve. But Israel pipol don break di kovenant wey dem make with Yu. Dem skata yor altar kon kill all yor profets. Na only mi remain and dem won kill mi too.”


Jezebel kon send message go meet Elijah dey warn am sey, “Make di juju dem judge mi, if I nor kill yu by dis time tumoro, just as yu kill di Baal profets.”


Wen King Ahab si Elijah, e kon sey, “My enemy, yu don find mi si abi?” Elijah ansa, “Yes! I don find yu si. Yu don do wetin nor dey good at-all for God eye.


Una go tell dem make dem put am for prison kon gi-am bread and wota till I go kom back.”


King Ahab ansa, “E get anoda one, en name na Mikaya wey Imlah born. But I hate am, bikos e nor dey profesai anytin wey dey good give mi, na only bad tin e dey tell mi.” King Jehoshafat kon sey, “Make yu nor tok like dat!”


Den di king sey, “Make God ponish mi if I nor kut Shafat pikin, Elisha head komot before today go end!”


But dem laf God messenjas, rijet en warnin and en profets. At last, God vex for en pipol and nobody fit stop am wen E dey vex.


But with all dis tins, di pipol go against Yu. Dem nor gri obey Yu and dem turn from yor law. Dem kill di profets wey kom warn and tell dem to turn kom meet Yu. Dem curse Yu many-many times,


Den for di end, evribody go sey, “Yes! Pipol wey dey obey God, go get dia reward. True-true, wi get God wey go judge di whole world!”


Pipol wey nor fit waka, go stand up dance and pipol wey nor fit tok, go dey shaut with happiness. River go dey flow kom from all di desert;


“Even as I ponish una shidren rish, dem nor gri shange or listin as I dey korrect dem. Just as lion dey kill en enemy, na so too una don kill una profets finish.”


Oga God sey, “True-true, Judgement day dey kom; e go kom like strong fire. All doz sturbon and wiked pipol go fall and dat day dem go burn die. Both dia rut and branches go burn finish.


make una happy and make belle sweet una, bikos na big tin dey wait una for heaven. Make una remember sey, na so di profets wey kom before una, sofa too.”


Wen Elizabet hear as Mary dey greet am, di pikin for en belle jump and di Holy Spirit kon enter Elizabet body.


Bikos as yor greetin rish my ear, di pikin wey dey my belle kon happy bigin jump.


But make una love una enemies kon do good and make una nor espect anytin back wen una borrow anybody sometin. Na dis go make God pay una back and una go bi en shidren, bikos God ensef dey do good for wiked pipol and doz wey nor dey sey tank yu.


e tell am, “Stand up.” Di man kon jump up and e bigin waka.


Di man jump up bigin waka, e follow dem enter di temple dey waka, dey jump up-and-down, dey praiz God.


So di apostles komot from der dey happy well-well sey God don give dem di shance to sofa, bikos of Jesus Christ.


Wi still dey happy inside di wahala wey wi dey face, bikos wi know sey trobol go make us endure,


I dey happy as I dey weak with all di curse, trobols, ponishment and wahala wey I dey sofa bikos of Christ, bikos anytime wey I dey weak, na dat time, I dey-dey strong.


I dey happy for di sofa wey I dey sofa for una and for di church wey bi Christ body, so I dey take my body komplete wetin remain for Christ sofa.


If wi bear with am, den wi go reign with am too and if wi sey wi nor know am, en too go sey, e nor know us.


E feel sey e betta make dem laf am, bikos of di Mezaya wey dey kom, instead make e dey enjoy di fine-fine tins for Egypt. E do like dis, bikos e put en eye for God reward.


Nobody fit make belle sweet God without faith, bikos anybody wey dey kom meet am, must bilive sey, E dey alive and E dey reward pipol wey dey find am si.


My brodas and sistas, make una dey happy wen una dey face temptashon,


Instead, make una dey happy as una dey sofa for Christ, so dat wen God go show una en glory, belle go sweet una.


Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, I go gi-am some manna wey dem hide for heaven. I go gi-am white stone and for dat stone, dem go rite new name put and nobody go fit undastand am, escept di pesin wey I give di stone.’ ”


Anybody wey fit bear and obey mi rish di end, I go gi-am authority ova all di nashons.


Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, I go allow am chop from di tree for God Paradise and dis tree dey give life.’ ”


Di pesin wey win, go inherit dis tins. I go bi en God and e go bi my pikin.


Anybody wey fit bear rish di end, I go make am pila for my Papa Temple and e nor go ever komot from der. I go rite my Papa name; David Town; di new Jerusalem wey dey kom from heaven and my own new name, put for en body.


Anybody wey fit bear rish di end, go wear white klot like dem and I nor go remove en name from my Life Book, but I go tok about am for my Papa and en angels front.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan