Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 6:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Una wey pipol hate, rijet, curse and dey koll bad pipol bikos of Man Pikin, God go bless una

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 6:22
29 Iomraidhean Croise  

Dem dey tell odas sey, “Make una nor near us, wi dey too holy for una to tosh! Doz pipol bi like smoke for my nose, bikos my vexnashon for dem bi like fire wey nor dey kwensh.


Make una listin to wetin God tok, “Una own pipol hate and porshu una bikos una dey obey my name. Dem dey laf una sey ‘Oya! Make una honor God name na! Make belle sweet una na!’ ” But make una nor worry, bikos na dem go shame.


Bikos of mi, dem go drag una go meet rulers and kings, so dat una go tok about mi give dem and Gentile pipol.


Evribody go hate una bikos of mi. But anybody wey fit bear rish di end, God go save am.


Pesin wey hold en life tait, go luz am, but anybody wey luz en life bikos of mi, go gain am.”


Dem karry di pikin go outside, kon kill-am. So, wetin una tink sey di owner go do di tenants?


Evribody go hate una bikos of my name.


Make una happy, una wey dey hongry, bikos una go beleful. Make una happy, una wey dey kry naw, bikos una go laf.


Many pipol and many Jew oga kon bilive Jesus, but bikos of di Farisee pipol, doz wey bilive nor fit tok for publik about Jesus Christ, so dat dem nor go drive dem komot for di sinagog.


Dem go drive una komot for di sinagog and di time dey kom wen di pesin wey go kill una, go tink sey e dey do God work.


I don give dem yor word and bikos of dat, di pipol for world hate dem, since dem nor bilong to di world, as misef nor bilong to di world.


Pipol like una, but dem nor like mi, bikos I dey tell dem sey wetin dem dey do nor good.


Dem kon tell di man, “Na for inside sins born yu, yu tink sey yu go fit tish us anytin?” So dem drive am komot from di place.


As e tok finish, pipol wey gada dey listin to am kon dey shaut, “Karry dis man komot! Make dem nor allow am live!”


Bikos wi don si dis man sey e find trobol and kause wahala among all di Jew pipol for di world and naim dey lead di gang wey dem dey koll, ‘Di Nazarenes’.


True-true I go show am how e go sofa, bikos of my name.”


Di pesin wey fit bear wen problem kom meet am, make e happy, bikos e don show sey en faith strong and e go get di crown wey get life, wey God don promise sey E go give pipol wey love am.


But if yu sofa bikos yu dey do good, make yu nor fear doz wiked pipol, bikos God don bless yu bi dat.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan