One day, some men dey beri pesin wen dem si some pipol dey kom attack dem. So dem kon trow di dead body inside Elisha grave. As di dead body tosh Elisha bone, di man wey don die kon wake-up.
Anywhere wey Jesus go, weda na village or town or farm, dem go karry di pipol wey nor well for dia market place kon ask Jesus weda dem go fit tosh en klot and evribody wey tosh am, kon well.
One day, wen Jesus dey tish, some Farisee pipol and di law tishas kon kom from all di village wey dey Galilee, Judea and Jerusalem, dem sidan near Jesus and God pawa dey with am to heal pipol.