1 Jesus dey waka pass where dem plant korn put and en disciples kon plok some korn dey chop.
“ ‘For seven days, una must chop bread wey nor get yist. So for di first day, una must remove di yist wey dey una house, bikos if anybody chop bread wey get yist from di first day go rish di sevent day, I go kill-am.
“ ‘Una must kount seven weeks from di day afta di Sabat Day, wen una bring di first korn wey una harvest kom give God.
For di first day, una go gada woship and una nor go do any work.
Nobody go like to drink new wine afta e don drink old wine. Bikos e go sey, ‘Na di old wine betta pass.’ ”
For anoda Sabat Day, Jesus enter di sinagog dey tish. One man wey en rite hand don die dey der.
From di day wey una bigin harvest, make una kount seven weeks.
And wen una enter una neighbour grain field, una fit plok di grain head with una hand, but make una nor kut am with knife.