Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 5:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Wen Simon si wetin happen, e kon knee down for Jesus front dey sey, “Abeg, nor near mi Oga God, bikos I bi sina.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 5:8
19 Iomraidhean Croise  

Den, David fear God well-well kon sey, “How I go take karry di Kovenant Box follow body naw?”


Di woman go meet Profet Elijah kon sey, “God savant, why yu do mi dis kind tin? Yu kom here kon make God remember my sins, den kill my pikin?”


“True-true, I dey tok like fool since, wetin I go fit ansa? I nor go try tok anytin again.


Dem kon tell Moses, “Make yu tok to us and wi go listin, but make yu nor let God tok to us, so dat wi nor go die.”


I kon sey, “My own don finish, bikos evry word wey dey komot from my mout, na sin full am and I dey stay with pipol wey all dia words na sin and naw, I don use my eyes si Oga God wey bi di king wey get pawa.”


Wen di disciples hear di vois, dem fear kon fall face groun.


Dem enter di house, si di pikin with en mama kon knee down woship am. Den dem open dia bag kon gi-am some gifts wey bi, gold, frankincense and myrrh.


But di offisa sey, “Oga God, I nor big rish who yu go enter en house, instead just tok and my savant go well.


So, dem kon do sign give di oda pipol wey dey follow dem work, make dem kom help dem. Wen dem put all di fish inside di two kenu, di kenu dem kon dey won sink.


Pita and all di pipol wey dey with am sopraiz well-well wen dem si all di fish wey dem katch.


Wen Mary si Jesus, e fall for en front kon sey, “Oga God, if to sey yu dey here, my broda nor for die.”


Evritin wey wi dey si naw bi like ordinary image for mirror; but for dat time, wi go si am, face-to-face. Naw wi nor know evritin, but den wi go know, just as God really know us.


Wen I si am, I fall near en leg like sey I don die. But E tosh mi with en rite hand, kon sey: “Nor fear! Na mi bi di First and di Last,


Manoah tell en wife, “Wi go die, bikos wi don si God!”


Di pipol wey dey stay Bet-Shemesh kon ask, “Na who go fit stand before di Oga awa God wey dey holy? Na where wi won send di box go, so dat God go leave us?”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan