Nobody go pour new wine inside old wine bag, bikos di bag go burst and di wine go pour trowey, den di wine bag go tear. Na dis make dem dey put new wine inside new wine bag, so dat di wine nor go trowey and di wine bag nor go tear.”
E still tell dem one parabol sey: “Nobody dey tear new klot take pash old one. If e do like dat, e go fit spoil di new klot and di new klot piece nor go mash di old one.
Di wine bag get betta wine wen wi start di journey, but make una si how dem don skata finish. Awa klot and sandals don skata, bikos di journey long well-well.”