Bikos di Pesin wey kreate una, go bi una husband. Na God wey get pawa bi en name. Israel God wey dey holy go save una. Dem dey koll am di God of di whole eart.
Di Oga yor God dey with yu and E dey always diliver yu. E dey happy well-well bikos of yu. En love nor go make yu fear again and E go dey sing sweet songs bikos of yu.’
Jesus ansa, “Pipol wey kom marriage nor fit mourn if di man wey dey marry dey with dem! Abi e dey happen like dat? But di day go kom wen dem go take di man wey dey marry komot from where dem dey, dat time, dem go fast.
Den some pipol tell Jesus, “John disciples dey fast and pray and di Farisee disciples dey do di same tin too, but yor disciples just dey chop and drink anyhow.”
Di pesin wey won marry new wife naim bi di bridegroom. En friend, wey bi di best man, dey listin to am. E go dey happy well-well wen e hear di bridegroom dey tok. Na dis dey make mi happy and my joy don full.