Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 5:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 But di Farisee pipol and some law tishas kon dey vex for Jesus disciples sey, “Why una dey chop and drink with tax kollectors and sinnas?”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 5:30
16 Iomraidhean Croise  

Dem dey tell odas sey, “Make una nor near us, wi dey too holy for una to tosh! Doz pipol bi like smoke for my nose, bikos my vexnashon for dem bi like fire wey nor dey kwensh.


If una love only di pipol wey love una, wetin una go gain? Na so bad pipol dey do too, abi nor bi so?


Wen di Farisee si wetin dey happen, dem kon bigin ask di disciples, “Wetin make una tisha dey follow tax kollectors and sinnas dey chop?”


Wen di law tishas and di Farisee pipol si sey e dey chop with sinnas and tax kollectors, dem kon ask en disciples, “Why una oga dey chop with tax kollectors and sinnas?”


(Bikos di Farisee and Jew pipol, nor dey chop unless dem wosh dia hand akordin to dia tradishon.


Jesus ask dem, “Wetin una dey argue about?”


Di Farisee kon stand dey pray about ensef sey: ‘God, I tank yu sey I nor bi like oda pipol wey dey play wayo, dey sin, pipol wey dey kommit adultery or even like dis tax kollector.


Wen di pipol si wetin happen, dem kon dey komplain dey sey, “Jesus don go visit dat man wey bi sina.”


One day, wen Jesus dey tish, some Farisee pipol and di law tishas kon kom from all di village wey dey Galilee, Judea and Jerusalem, dem sidan near Jesus and God pawa dey with am to heal pipol.


So di law tishas and di Farisee pipol kon dey tell diasef sey, “Who bi dis man wey dey shalenge God like dis? Who fit forgive sin escept God?”


But God Pikin kom, dey chop and drink and una sey, ‘Si am, long-trot, drunkard, na tax kollectors and sinnas bi en friend.’


Wen di Farisee wey invite Jesus si wetin dey happen, e kon tok for en mind sey, “If dis man na profet true-true, e for know sey dis woman wey dey tosh am so, na sina e bi.”


So kworel kon start between dem and some oga for di law matter wey bi Farisee pipol kon stand up dey oppoz di Sadusi pipol sey, “Wi nor si any bad tin wey dis man do. Una know weda na spirit or angel tok to am?”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan