Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 5:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 But make una for know sey Man Pikin get pawa for dis world to forgive sin, e kon tell di man wey nor fit waka, ‘I tell yu, get up, karry yor bed make yu dey go house.’ ”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 5:24
26 Iomraidhean Croise  

But wen e si all di good tins wey en sofa bring, belle go sweet am. My savant wey I like well-well, go bear plenty pipol ponishment and I go forgive dem bikos of am.


As I still dey look for di vishon for nite, I si wetin bi like human being. E dey waka kom with kloud wey dey round am, den e go show ensef give di Pesin wey dey live forever.


Wen Jesus Christ rish Caesaria for Filippi aria, e kon ask en disciples, “Na who pipol sey Man Pikin bi?”


“Wen Man Pikin and en angels go kom with en glory, e go sidan for en king throne.


Jesus ansa am, “Yu don tok am. But I tell yu, from naw go, yu go si Man Pikin sidan for God rite hand dey kom down for kloud from heaven.”


Den Jesus Christ waka near kon tell dem, “God don give mi all di pawa wey dey heaven and eart.


So di news about Jesus kon spread go evriwhere for Siria. Dem kon bring pipol wey nor well, wey nor fit waka, pipol wey devil dey worry and di pipol wey demon dey inside dem, kom meet am and e heal all of dem.


But make una know sey Man Pikin get pawa for dis world to forgive pipol dia sins.” So e kon tell di man wey nor fit waka, “Stand up, karry yor bed, make yu dey go yor house.”


So Jesus tosh di man kon sey, “I like to do am. ‘Oya! Make yor body klean naw!’ ” At wons, di leprosy komot for di man body.


Some men karry one man for bed wey nor fit waka, kom. Dem kon dey try to karry am enter di house kom meet Jesus,


Wish one eazy to tok? ‘I forgive yu yor sin?’ or ‘Get up make yu waka?’


Den e waka go tosh di koffin and di men wey karry am kon stop. Jesus kon sey, “Yong man, get up!”


But Jesus whole di girl hand kon sey, “My pikin, get up.”


Wen e don tok dis finish, e kon shaut, “Lazarus, kom out!”


Just as yu don give mi pawa ova all di pipol for di world, na so too I go give life wey nor dey end to evribody wey yu give mi.


Nobody don go heaven before, escept Man Pikin wey kom down from heaven and e go-go back der.


Di Papa don give en pikin di pawa to judge pipol.


e tell am, “Stand up.” Di man kon jump up and e bigin waka.


But God don promote am sey make e sidan for en rite hand kon gi-am big pozishon as Oga God and di Pesin wey go save di world, so dat Israel shidren go turn from dia sin kom meet God make e forgive dem.


Pita kon tell am, “Aeneas, Jesus Christ, wey bi di Mezaya, won heal yu naw. So make yu stand up, karry yor bed!” At wons, e get up kon karry en bed.


But Pita drive all of dem go outside, den e knee down kon pray. E turn face di dead body kon sey, “Tabita, get up!” Naim di woman open en eye and wen e si Pita, e kon sidan.


And di pesin wey stand for di lampstand centre, bi like Man Pikin. E wear long dress with gold belt for en waist.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan