Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 5:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Jesus know wetin dem dey tink, so e ask dem, “Why una dey tink like dis sef?

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 5:22
15 Iomraidhean Croise  

Den e tell Solomon, “My pikin, I kommand yu sey make yu know yor papa God and make yu use all yor mind and heart take serve am. E know all wetin wi dey tink and wetin wi wont. If yu go meet am, E go take yu, but if yu turn from am, E go abandon yu forever.


Yu know wen I sidan or wen I stand up. Yu know wetin I dey tink even wen I dey far from Yu.


God hate evil plans, but E like betta words.


I know wetin dey dia mind and wetin dem dey do. I dey kom gada all di nashon togeda and wen dem don kom togeda, dem go si wetin my pawa fit do


Dis na wetin God wey get pawa dey tell Gog: “Wen dat time don rish, yu go start to tink of di wiked tins wey yu go do.


Wen Jesus hear sey dem dey plan to kill-am, e kon komot from der. Many pipol follow am and e kon heal all of dem wey nor well.


Wen Jesus know wetin dem dey tink for dia mind, e kon sey, “Evry kingdom wey dey fight with ensef go skata and know town or family wey dey fight demsef, go fit stand.


Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon ask dem, “Wetin make una dey tink dis kind bad tin for una mind?


Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon tell dem, “Why una dey tok about bread wey una nor take? Una nor dey si or undastand? Na so una foolish rish?


Den Jesus kon sey, “Why una dey fear and nor bilive?


So di law tishas and di Farisee pipol kon dey tell diasef sey, “Who bi dis man wey dey shalenge God like dis? Who fit forgive sin escept God?”


Wish one eazy to tok? ‘I forgive yu yor sin?’ or ‘Get up make yu waka?’


But Pita tell am, “Ananias, why yu allow Satan enter yor heart and yu kon dey lie give di Holy Spirit? Why yu keep some for di money wey una sell di land, for unasef?


God word dey alive, e get pawa and e sharp pass knife wey get two sharp side. Di word dey divide pesin soul from en spirit and e dey divide bone from bone; bikos God know wetin wi dey tink for awa mind.


I go kill all en shidren, den all di church pipol go know sey, I know wetin dey for pipol mind and heart. I go reward evribody akordin to wetin e do.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan