Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 4:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Den e tell am, “I go give yu all dis place and all di honor wey follow am as yor kingdom, bikos dem don gi-am to mi and I fit gi-am to anybody wey I wont.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 4:6
15 Iomraidhean Croise  

E kon dey boast give dem sey e get money well-well; many sons; how di king don promote am and how e dey important to di king pass any oda offisa.


Na God wey dey lead heaven sojas do am. E do am to stop dia pride and to ponish dia pipol wey oda pipol dey respet.


Deat go open en mout wide dey wait dem and all di big and betta pipol with doz wey dey celebrate for Jerusalem, go soon enter deat mout.


So, if yu bow down woship mi, I go give yu evritin.”


Di time to judge di pipol for dis world don rish and God go drive Satan, wey dey kontrol dis world komot.


I nor go tok too mush naw, bikos di devil wey dey rule dis world, dey kom and e nor get pawa for my body.


Na devil bi una papa and na di tin wey una papa wont, naim una dey do. E dey kill pipol from di biginnin and e nor dey support wetin good, as e nor get any good tin inside am. Anytime e dey tok, na di lie wey dey inside am, na-im e dey tok, e bi lie-lie pesin, bikos naim bi lie-lie papa.


E nor sopraiz us, bikos even Satan dey pritend sey en na angel wey get lite.


bikos una dey do wetin di world wont. Una dey obey wiked pawas wey dey rule di air and kontrol sturbon shidren.


Human being bi like grass and wetin make am fine, bi like flower; di grass go dry and di flower go die,


Wi know sey wi bi God shidren and dis world wey wi dey so, na wiked pipol dey rule am.


Dis dragon na di old snake wey bi di devil or Satan, wey dey deceive di world. Dem trow am kom down from heaven with en angels.


Di beast wey I si, bi like leopard, but en leg bi like bear leg and en mout bi like lion own. Di dragon kon gi-am pawa, en throne and strong authority to rule.


Satan gi-am pawa to fight with God pipol and to win dem. E still gi-am authority to rule evry tribe, group, language and kountries.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan