But Jesus tell am: “Make yu shut up! Yu demon, komot for en body.” Di demon trow di man for groun for dia front kon komot for en body, but di man nor wound.
Demons dey shaut dey komot from many pipol body, dey sey, “Yu bi God Pikin!” But Jesus warn dem make dem nor tok, bikos dem know sey, naim bi di Mezaya.
Dem kon tell Jesus, “Oga God! Oga God! Na die wi dey so!” Jesus get up kon kommand di breeze make e stop and di wota wey rof before, stop and evriwhere kon kwayet.