Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 4:34 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

34 “Abeg, make yu leave us alone, Jesus wey kom from Nazaret! Yu don kom distroy us? I know who yu bi, yu bi God savant wey holy.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 4:34
22 Iomraidhean Croise  

I go make yu hate woman and yor pikin go still hate pikin wey woman born. Pikin wey woman born go mash yor head and yu go bite dia leg.”


Di woman go meet Profet Elijah kon sey, “God savant, why yu do mi dis kind tin? Yu kom here kon make God remember my sins, den kill my pikin?”


Bikos God nor go leave my soul inside grave or allow en holy pikin rotin for der.


“God don set seventy weeks as di time wen E go take free yor pipol kon ribuild en temple. Una dey sofa, bikos of all di evil and wiked tins wey una do. Afta, E go forgive una sins and judge una well forever, so dat wetin E tok, go happen. Den E go anoint di holy temple again.


Di demons kon hala, “God Pikin, make yu leave us o-o, abi yu kom sofa us wen time neva rish?”


“Make yu leave us o-o, Jesus wey kom from Nazaret! Abi, yu don kom distroy us? I know who yu bi. Yu bi God Pikin wey dey holy.”


So, Jesus heal many pipol wey nor well with difren-difren diziz and e drive many demon komot from pipol body. But e nor let di demons tok, bikos dem know who e bi.


Den e shaut, “Make yu leave mi, Jesus, yu wey bi God Almighty Pikin! I take God beg yu, nor sofa mi!”


Di angel ansa am, “Di Holy Spirit pawa go kover yu. So di pikin wey yu go born, go dey holy and dem go koll am God Pikin.


Inside di sinagog, one man wey evil spirit dey en body kon dey shaut,


Demons dey shaut dey komot from many pipol body, dey sey, “Yu bi God Pikin!” But Jesus warn dem make dem nor tok, bikos dem know sey, naim bi di Mezaya.


Wen e si Jesus, e fall for en front kon shaut, “Make yu leave mi! Jesus, God Pikin, Abeg yu, nor ponish mi!”


Den all di pipol for Gerasenes and di aria wey near der, kon tell Jesus make e leave dem, bikos dem dey fear well-well. So Jesus and en disciples enter kenu kon komot for der.


so dem kon beg dem sey make dem nor vex. Afta dem bring dem kom out, dem kon beg dem well-well sey make dem leave di town.


bikos I know sey God nor go allow mi stay for grave or make my body rotin for groun.


Una sey una nor wont Jesus Christ, di holy and Raitious Pesin, instead una sey make dem release anoda pesin wey dey kill pipol give una.


“True-true, Herod, Pontius Pilate, Israel pipol and doz wey nor bi Jew kon gada for di town against Jesus Christ, yor holy savant wey yu choose


So as di shidren get flesh and blood, en too get flesh and blood like dem, so dat thru deat, e go fit distroy Satan wey get pawa to kill


Yu bilive sey na only one good God dey. Demons bilive so too and fear dey katch dem well-well.


But pesin wey dey like to sin, na devil pikin, bikos devil dey sin from di biginnin. Na dis one make God Pikin kom dis world, so dat e go skata all di work wey devil dey do.


E seize di dragon, dat old snake wey bi Satan di devil and dem don tie am der for like 1,000 years.


“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Filadelfia: ‘Di Pesin wey dey holy and true, wey whole David key; wen dis pesin open door, nobody go fit klose am and wen e klose door, nobody go fit open am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan