28 Wen dem hear dis tins, all di pipol for di sinagog kon dey vex.
Asa vex well-well for di profet, so e kon put am for prison. Dat time, King Asa still vex opress some pipol.
So dem tie mi with rope kon drop mi small-small for inside Prince Malkijah well wey dey di palis. Di well dry bikos wota nor dey inside.
Wen Herod si sey di wise men deceive am, e vex well-well, so e send sojas make dem go kill all di boys wey don rish two years kom down, bikos e don rish two years wen di wise men kom meet am sey, dem si di star.
Pipol wey get leprosy many for Israel for profet Elisha time, but God nor heal any one escept Naaman, wey kom from Siria.”
Dem push Jesus komot from di town kon take am go di hill wey dia town dey on-top, make dem for trow am down.
But di Farisee pipol and di law tishas kon vex sotey dem nor dey si road again, so dem kon bigin ask diasef, “Wetin wi go do Jesus Christ.”
Wen di priest oga dem hear dis tin, dem kon vex well-well and won kill di apostles.
As di kansol membas hear all di tins wey Stefen tok, dem kon dey vex well-well.