Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 3:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 So John tell di pipol wey kom make e for baptize dem sey, “Una wey bi snake shidren! Who warn una make una run komot from God ponishment wey dey kom?

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 3:7
12 Iomraidhean Croise  

I go make yu hate woman and yor pikin go still hate pikin wey woman born. Pikin wey woman born go mash yor head and yu go bite dia leg.”


Di evil wey una dey do dey bad like di poizin wey dey snake wey dem just born.


Una, snake shidren! How una won take tok good word since una dey wiked? Na wetin full pesin heart, naim en mout dey tok.


“Una bi snake! Wiked snake shidren! How una go take eskape hell?


and e kon baptize dem inside Jordan River, afta dem konfess dia sins.


Na devil bi una papa and na di tin wey una papa wont, naim una dey do. E dey kill pipol from di biginnin and e nor dey support wetin good, as e nor get any good tin inside am. Anytime e dey tok, na di lie wey dey inside am, na-im e dey tok, e bi lie-lie pesin, bikos naim bi lie-lie papa.


kon tell am, “Yu devil pikin wey nor like good tin, na so-so wayo and bad tins yu sabi do, yu nor go stop to dey oppoz God?


And una dey wait en pikin wey dey kom from heaven. Dis na en pikin, Jesus wey E wake from deat and na-im go save us from God vexnashon wey dey kom.


God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.


But pesin wey dey like to sin, na devil pikin, bikos devil dey sin from di biginnin. Na dis one make God Pikin kom dis world, so dat e go skata all di work wey devil dey do.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan