I go lead doz wey nor dey si, pass di road wey dem neva travel pass before. I go turn dia darkness to lite kon make rof road smooth for dem. Dis na wetin I promise and I go do dem; I nor go fail.
Evry tree for di land go know sey na mi bi God. I go kut di trees wey tall and di ones wey short, I go make dem tall. I go make green trees dry kon make dry trees, green. Mi wey bi God don tok and I go do wetin I sey I go do.”