Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 3:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 John kon go all di aria wey dey round Jordan River dey prish sey make pipol turn from dia sin kom meet God and make dem baptize, so dat God go forgive dem.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 3:3
12 Iomraidhean Croise  

“I dey baptize una with wota make una for turn from sin kom meet God, but di pesin wey go kom afta, strong pass mi. I nor big rish to luz di rope wey dey en shoe, na-im go baptize una with Holy Spirit and fire.


E go make many pipol follow God.


wey go make pipol know sey, God go save dem, bikos E go forgive dem dia sins.


Di Holy Spirit enter Jesus body kon karry am from Jordan River go inside wildaness.


All dis tins happen for Betany where pipol dey cross Jordan River kom meet John, make e baptize dem.


Some among dem go meet John kon tell am, “Oga God, di pesin wey dey with yu for di oda side for Jordan River, wey yu tok about before, en too, dey baptize pipol and evribody dey rush go meet am.”


Before Jesus kom, John di Baptist don prish to all Israel pipol sey make dem turn from sin kom meet God and make e baptize dem.


Paul kon tell dem, “John baptize pipol wey turn from sin kom meet God with wota kon tell dem make dem bilive di pesin wey go kom afta am and na dat pesin, bi Jesus Christ.”


Naw, wetin yu dey wait for? Get up, make dem baptize yu, so dat God go forgive yu yor sin, as yu koll en name.’


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan