Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 3:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 di Holy Spirit kom down for en head like dove. Den one vois tok from heaven sey, “Yu bi my Pikin wey I love well-well and yu dey make belle sweet mi.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 3:22
21 Iomraidhean Croise  

Den di king sey, “I go tell una wetin God kommand. God tell mi sey: ‘Yu bi my pikin! Today, I don bi yor papa!


God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.


“Na my savant wey I choose bi dis, di One wey I love, wey I dey happy with. I go put my Spirit inside am and e go judge di world.


As e still dey tok, one brite kloud kon kover dem and one vois kon sey, “Dis na my Pikin wey I love. Make una listin to am!”


Since e trust God, make God kon save am naw, bikos e sey, ‘I bi God Pikin!’ ”


Jesus kom from Galilee make John for baptize am for Jordan River.


As Jesus dey kom out from di wota afta John don baptize am, heaven open and John kon si God Spirit wey bi like dove, stay on-top Jesus head.


Naim one vois from heaven kon sey, “Dis na My pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”


Den one vois tok from heaven sey, “Yu bi My Pikin wey I love and yu dey make belle sweet Mi well-well.”


Dat time, Jesus kom from Nazaret wey dey for Galilee and John kon baptize am for Jordan River.


Den, kloud kover dem and one vois kon tok from di kloud sey, “Dis na My only pikin wey I love. Make una listin to am!”


“Na only God get Glory for heaven and eart, make peace and favor dey with evribody.”


Den Jesus tell dem, “Today, di tins wey dem rite for God word for where I read, don happen, just as una hear am wen I dey read am.”


Den John bear witness sey, “I si God Spirit wey kom down like dove from heaven kon stay for Jesus head.


Papa, make yu honor yor name.” Den one vois tok from heaven sey, “I don honor am before and I go honor am again.”


And my Papa wey send mi, en ensef don bear witness about mi. Una neva hear my Papa vois or si am before.


Jesus Christ wey kom from Nazaret, na-im God give di Holy Spirit and pawa. Una still know how e do good for evriwhere kon heal pipol wey devil dey opress, bikos God dey with am.


E save us from darkness pawa and put us for di kingdom wey E give di pikin wey E love.


Una don kom meet Christ, wey bi di stone wey dey alive. Pipol rijet am, but God choose am and e dey important for God eye.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan