Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 24:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 E nor dey here again, God don wake am! Una remember wetin e tell una wen e dey Galilee sey,

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 24:6
19 Iomraidhean Croise  

As Jonah dey inside big fish belle for three days and nites, na so Man Pikin go dey for grave for three days and nites too.


From dat time go, Jesus kon dey tell en disciples sey, e go must enter Jerusalem where di eldas, priest oga dem and di law tishas go sofa and kill-am, but for di third day, e go wake-up.


dey sey, “Oga God, wi remember sey wen dat wayo man still dey for dis world, e tok sey, ‘Afta three days, e go wake-up.’


E nor dey here, bikos God don wake am up, just as God promise. Make una kom si di place where e liedan put before.


But e tell dem, “Make una nor fear. Una dey find Jesus wey kom from Nazaret, wey dem kill. God don raiz am from deat! E nor dey here again. Make una look di place wey dem put am before.


Den Jesus bigin tish dem sey, “Man Pikin must sofa many tins, bikos di eldas, di priest oga dem and di law tishas go kill-am and afta three days, e go wake-up from deat.”


kon tell dem, “Jesus don really wake-up and e don appear to Simon!”


Fear katch di wimen and dem kon face groun. But di men tell dem, “Why una dey find pesin wey dey alive for where dead body dey?


Den Jesus tell dem, “God Pikin go sofa many tins: di eldas, di priest oga dem and di law tishas go rijet am, dem go kill-am and afta three days, God go wake am up.”


“Make una nor forget wetin I won tell una, dem go sell God Pikin give human being.”


But God kon raiz am up afta E don gi-am pawa to win deat, bikos deat nor get pawa to hold am.


Una remember sey wen I dey with una before, I tell una all dis tins.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan