48 Una bi witness for dis tins.
And unasef go tok about mi, bikos una dey with mi from di biginnin.”
from wen dem baptize am, until e go up leave us; make e kon join us tell pipol di trut sey, Jesus Christ don raiz-up from grave.”
but una go get pawa wen di Holy Spirit don enter una life and una go tell pipol about mi for Jerusalem, for evriwhere for Judea and Samaria go rish all di far place wey dey dis world.”
All of us si di tins wey e do for Judea and Jerusalem, but dem hang am for three kon kill-am.
Nor bi evribody si am, but na di ones wey God don choose, wey follow am chop and drink afta e don wake-up from deat.
and for many days, e appear to di pipol wey dey follow am from Galilee go rish Jerusalem. Na dis pipol kon dey bear witness sey, dis tins na true.
God don raiz dis Jesus Christ up and evribody si am.
bikos yu go bi witness to all di pipol, about wetin yu don si and hear.
Una kill di pesin wey dey give pipol life, but God raiz am from deat and wi bear witness sey dis na true.
With God pawa, di apostles kon dey bear witness sey Jesus Christ wake-up from deat and God favor kon dey show for dia life well-well.
All of us know sey dis tin na true and di Holy Spirit wey God don give to pipol wey dey obey am, dey still bear witness sey, dis tin na true.”
Mi wey bi una fellow elder, wey si how Christ sofa and go share for God glory wey go soon kom, dey beg di eldas among una sey: