E get one woman wey dey listin to us, en name na Lydia and e kom from Tiatira. E dey fear God well-well and dey sell purpol klot. God open en heart to bilive evritin wey Paul tok.
yu go open dia eyes make dem for waka komot from darkness enter lite. Make dem komot from Satan hand, go meet God, so dat God go forgive dem dia sins and dem go follow di pipol wey God don make klean, bikos dem bilive am.’
Bikos na lite dey make evritin shine kom out and na dis make dem rite sey: “Wake-up; yu wey dey sleep! Make yu raiz from grave and Christ go shine for yor life!”
Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.
“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Filadelfia: ‘Di Pesin wey dey holy and true, wey whole David key; wen dis pesin open door, nobody go fit klose am and wen e klose door, nobody go fit open am.