34 kon tell dem, “Jesus don really wake-up and e don appear to Simon!”
Make una go tell en disciples and Pita sey, Jesus don go Galilee go wait for dem. Una go si am for der, as e tell una before.”
E nor dey here again, God don wake am! Una remember wetin e tell una wen e dey Galilee sey,
Wen Jesus si di woman, e sorry for am kon tell am, “Make yu nor kry again.”
kon send dem go ask Jesus sey, “Na yu bi di pesin wey wi dey espect, abi make wi wait for anoda pesin?”
Na di same apostles e show ensef many time sey, e still dey alive afta di sofa wey e sofa. Dem si am for forty days and e tell dem about God kingdom.
Christ appear to Pita, den to di twelf apostles.