God wey get pawa don tish mi wetin I go tok, so dat I go fit make pipol wey dey weak, strong. Evry morning, I dey-dey happy to hear wetin God dey tish mi.
But wen I sey, “I go forget God and I nor go tok with en name again,” na dat time yor message dey bi like fire wey dey burn inside my body. Even wen I try to pritend sey nor-tin dey happen, I nor dey fit.
Dem kon gri for di day wen dem go meet am and dem plenty wey kom en house kon meet am. So, from morning till evening, Paul kon dey esplain tins give dem. E dey tok about God kingdom and dey try to show dem wetin Moses Law and di profets tok about Jesus Christ.
God word dey alive, e get pawa and e sharp pass knife wey get two sharp side. Di word dey divide pesin soul from en spirit and e dey divide bone from bone; bikos God know wetin wi dey tink for awa mind.