25 So Jesus tell dem, “Una nor get sense and una nor dey kwik bilive wetin all di profets tok.
Man Pikin go die as dem rite about am, but curse dey di pesin head wey go sell am! E for betta sey dem nor born di pesin at-all.”
Den Jesus appear to di eleven disciples wen dem dey chop. E shaut give dem since dem nor bilive, bikos of dia strong heart.
E kon tell dem, “Na so una fool rish? Una nor know sey anytin wey from outside enter pesin belle nor go fit make am dirty for God eye?
Jesus kon ask en disciples, “Una wey nor bilive! How long I go stay with una? How long I go dey bear with una? Make una bring di boy kom meet mi.”
Den some pipol wey dey with us kon go di grave and dem si evritin as di wimen tok, but dem nor si Jesus.”
Una dey read God word well-well, bikos una bilive sey na wetin una read, go give una life wey nor dey end and na dis same word dey tok about mi,
Bikos na wetin I receive, naim bi di first important tin wey I give una; sey Christ die for awa sins as dem rite for God word