53 Den e karry di body from di cross, wrap am with linen klot kon put am for di grave wey e dig inside rock, where dem neva beri anybody put before.
Even doh e nor do any bad tin or tok lie, dem plan to put am for grave with wiked pipol but dem kon beri am for rish man grave.”
Josef buy linen klot, bring Jesus body kom down from di cross kon take di klot wrap am, den e put am for grave wey dem dig inside rock. Den e roll big stone kover di grave mout.
E go meet Pilate kon ask for Jesus dead body.
Dat day na Friday wen dem dey ready for Sabat Day serimony.
One gardin dey near di place where dem kill Jesus and one new grave wey dem neva beri anybody put before, dey inside di gardin.
Wen dem don do evritin wey Bible tok about am, dem bring am down from di cross kon put am for grave.