50 E get one man for di kansol, wey bi Josef and e kom from Arimatea wey dey Judea. E bi betta pesin wey dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God Kingdom go kom.
One man dey Jerusalem wey en name bi Simeon and di Holy Spirit dey inside am. Di man dey fear God and dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God go free Israel.
Dem ansa, “Kornelius, di soja offisa, wey dey do good tins and dey woship God well-well, wey all Jew pipol dey respet, na-im send us kom. One angel kommand am sey make e invite yu kom prish gi-am.”