Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Luke 23:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 But dem still sey, “E dey kause wahala with wetin e dey tish pipol for Judea. E start am for Galilee and naw e don kom here!”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Luke 23:5
24 Iomraidhean Croise  

My enemies gada round mi like many dogs and bad-bad pipol dey kom katch mi. Dem don shuk my hand and leg.


Na lions gada round mi so! I dey with pipol wey won kill mi; pipol wey dia tit sharp like spear and arrow and wey dia words dey kut like swods.


Pipol wey just hate mi wen e bi sey I nor do dem anytin, many pass di hair wey dey my head. Doz my enemies wey won distroy mi without any rizin, too plenty to kount. Dem dey make mi pay for wetin I nor tif!


Wen Jesus don tish en disciples finish, e kon komot from der go tish and prish for difren towns for Galilee.


Afta dem born Jesus for Betlehem wey dey Judea, for di time wey Herod bi king, some wise men from east kon go Jerusalem


Wen Pilate si sey di pipol nor gri and trobol won start, e kon take wota wosh en hand for di pipol front dey sey, “Dis man blood nor dey my head. Make only una go kill-am!”


Jesus kon dey waka for Galilee dey tish inside dia sinagog. E prish about God Kingdom and dey heal pipol wey get difren-difren diziz and doz wey nor well.


Afta dem don put John for prison, Jesus kon enter Galilee dey prish di Good News sey,


Wen Jesus komot from der, di pipol wey know di law well-well and di Farisee pipol kon dey vex, so from dat time, dem kon bigin ask Jesus yeye kweshon about many tins


But dem shaut more-more dey sey, “Kill-am trowey.” Dem shaut sotey Pilate kon do wetin dem wont.


Wen Pilate hear dis one, e kon ask weda Jesus na Galilee pesin.


Wen day break, Jesus kon plan to go Galilee. Wen e si Filip, e tell am, “Make yu follow mi.”


Den, dem kon bigin dey shaut, “Kill-am trowey! Kill-am trowey! Make yu kill-am!” Pilate kon ask dem, “Una wont make I nail una king for cross?” Di High Priest dem kon sey, “Di only king wey wi get na Caesar.”


Dis na di first mirakle wey Jesus do and e happen for Kana wey dey Galilee. Dis na how e show en honor, so en disciples kon bilive am.


Some still sey, “Na-im bi di Christ”, but odas sey, “Na lie, Christ nor fit kom from Galilee.


Dem kon ask am, “Abi na Galilee yu too from kom? If yu look well, yu go si sey know profet go fit kom from Galilee.”


Una know wetin happen from Galilee go rish Judea afta John prish sey,


Wen di argument kon too mush and di kommanding offisa dey fear sey dem go tear Paul to pieces, e kon orda en sojas make dem enter di meetin and karry Paul komot for der by force.


Wen di priest oga dem hear dis tin, dem kon vex well-well and won kill di apostles.


As di kansol membas hear all di tins wey Stefen tok, dem kon dey vex well-well.


But di pipol klose dia ear bigin shaut and all of dem kon rush am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan