49 And evribody wey know Jesus before, stand for far and di wimen wey follow Jesus kom from Galilee, si di tins wey happen.
“God don make my family far from mi; I don turn strenja to pipol wey know mi.
I dey look for di rite pesin wey go kom help mi, but nobody dey even tink go my side! Nobody to help mi; nobody even kare about wetin go happen to mi.
Pipol wey I love and wey bi my friends, dey run from mi, bikos dem dey fear my diziz. Even my own family membas stand for far dey look mi.
Yu don allow pipol wey I love and doz wey love mi, dey run from mi. So, na darkness bi my best friend naw.
(Mary Magdalin and di oda Mary sidan for di oda side wey face di grave).
Mary Magdalin and Mary wey bi Josef mama dey look and dem si where dem beri Jesus put.
Many pipol follow Jesus and di wimen among dem kon dey kry.
Di wimen wey follow Jesus from Galilee kon follow Josef go si di grave. So dem put Jesus body inside.
and some wimen wey Jesus drive evil spirit and difren sickness komot for dia body, go with am: Mary (wey dem dey koll Magdalin), wey Jesus drive seven demon komot for en body,