Again Pilate ask dem, “Why? Wish bad tin e do? I nor si any bad tin wey e do wey go make am die, so I go give orda make dem flog am, den I go free am.”
Den, dem kon bigin dey shaut, “Kill-am trowey! Kill-am trowey! Make yu kill-am!” Pilate kon ask dem, “Una wont make I nail una king for cross?” Di High Priest dem kon sey, “Di only king wey wi get na Caesar.”